03/01/2024
*TO AVOID EMBARRASSMENT & UNNECESSARY PRESSURE THIS YEAR 2024;*
*1. Put your children for school wey you fit afford because expensive schools no guarantee good results. Just ensure say dem dey attend good affordable school✔*
*2. Rent house wey your power reach. No go stay house wey you go dey struggle to pay yearly✔*
*3. From the day your wife get belle, you get good 9 months to prepare. So prepare well, if possible do 'Osusu'. You go pack like a week to her due date. So that you no go begin run around dey find Money to borrow.✔*
*4. From the day you rent house, you suppose know say you go pay rent when rent due. So plan & save towards your next rent to avoid disgrace✔*
*5. Plan your life well & live within your means. No put your hand for where your power no reach, save more & spend less✔*
*6. E no make sense to dey buy food for your children every morning before dem go school because e dey cheaper to cook. So cook for your house✔*
*7. If you no get money for DSTV, go for GOTV & upgrade when your income don upgrade. Afterall na still the same CNN✔*
*8. Eat healthy food & protect your family from mosquitoes to avoid everyday hospital wahala✔*
*9. No copy your neighbour lifestyle, because una two pockets no be neighbours✔*
*10. No follow trends, If your power no reach bone straight, do Ghana weaving. Police no go arrest you✔*
*11. Keep your circle small, keep only friends wey get sense✔*
*12. Above all things, have fear of God, get integrity, work hard & dey prayerful.*
*God of Apostle Daniel grant you wisdom & success as you *SOAR* like the *EAGLE* in 2024 in Jesus name!
*PstRichardChuksDominion #
Religious organisation