11/03/2024
Wilful Ignorance by SisiAda❤
Knock knock
I want a little piece of advice, should I persist in ignorance when God has shown me the true light?
Why do I love ignorance when I can simply live a life of ease just by consistently following the Lord's instruction?
My friend, E get as E be, calabash wey don break, dem no dey use am carry water for head but you see dis life, some people go still use that calabash even if their body go drench with water.
So what are you saying in essence? you've not answered my curiosity. What have calabash and water got to do with ignorance and following God's light nah?
You dey make me laugh my sweet friend, you no know say, decision wey you make, na the choice wey you make. Imagine say, good calabash full ground but you decide to use the one wey break, na your choice na. You sef know say water wey go leak out from the calabash go wet you but you still salute your decision, come still carry the broken calabash with pride.
Hmmm... So my choice of using a broke calabash despite seeing good ones around is a product of my wilful ignorance...
Gbamm👋kai you get am, this my friend you know book ooo but sometimes you just choose to remain gidigba for your ignorance. See God go show people better way, give dem pastors, apostles, teachers, omo, na wetin dey their heart, dem wan do... So, dem make the choice to still dey flex with wetin dey play for their mind.
But sis, why can't God force me, let him force me, let him put a rope in my neck? Let him just force me to do His will... I'm tired of all this struggles. I want to move forward.
Sis, just dey there dey play🤓. You never read for Josh. 24:15, wey God talk say; choose you this day whom ye will serve; God no be slave master, him dey give us chance to choose ooo... You sef still dey play because if you really wan move forward and you don tire, you go do wetin this scripture talk for Genesis 27:40b; "your freedom go come to pass when you don become restless, then you shall break his yoke from your neck".
Father, I break this yoke of willful ignorance. I want to move forward. I want to embrace the light you have mapped out for my Life.
My friend, My Friend. You be correct babe... Now, you go waka go your closet, go talk to God one on one. Him dey wait for you. Oya, bring your hand, make we pray. In Jesus' Name...
Amen.