03/10/2022
Police for Lagos, Nigeria commercial capital say make pipo dey tame dia dog well becos if di dog bite pesin, na di owner police go arrest.
Benjamin Hundeyin, tok-tok pesin for di Command cut di warning afta two dogs belonging to one church for Lagos bite one man.
Di dogs bite di 36 year old man for all im body before dem rush am go hospital.
Di man die for Orile Agege General Hospital – di command say dem dey investigate di mata.