30/01/2022
IT IS THE WORK OF THE DEVIL
Chai devil don really suffer plenty accusations from us oh.
Something wey you open eye, carry your hands do, na devil you go still blame.
Sha sometimes e no dey surprise me coz e be like say we inherit from Adam and Eve oh.
Abeg eh make we leave devil small.
Make we really reason this statement 'it is the work of the devil'.
Baba God create us, come give us wetin we call free will.
Free will means say we fit choose to do anything wey we like.
So make I tell you now say anything wey you do na because say you choose to do am except for very clear cases wey person force you to do wetin you no wan do.
Any time devil come to tempt you, e dey tempt you based on the kind of things wey you don dey think about already.
Anything wey you dey feed your mind with na him devil go use as base to tempt you.
Na him make the psalmist talk say he go hide the Word of God for him heart so that him no go sin against God and the Bible talk for another place say make the word of God full our heart well well.
Make I tell you one interesting thing about the devil.
We know say normally lions dey dangerous but the Bible say the devil dey like roaring lion, him no be lion, na only Master Jesus be the real Lion.
Make I tell you wetin roaring lions dey do.
The roaring lions no dey hunt for food.
The roaring lions na mostly the older lions.
Because of their old age they go just stay for one side of the bush then the younger lions wey be the real danger go position for the opposite side of the bush.
So the roaring lion go just roar from him on angle then the fear fear animal go run go the opposite side come enter inside the main danger.
Na so the devil just dey operate.
The devil go just roar then you go just run go enter danger.
The devil go just drop the idea or ask you one kind careless question just to tempt you but las las the choice dey your hand.