26/05/2026
Outdoor wedding shoots under hot sun no be beans for photographers ππΈ
You go dey run up and down like say na Olympics, trying not to miss moments while the sun dey fight your camera settings π But if you understand your settings well, your work go sharp and stress go reduce small.
1. ISO β Keep am low low π
ISO 100 or below is your best friend for sunny outdoor weddings. The sun already dey bright enough, so no need to increase sensor sensitivity come add unnecessary grain. Low ISO = cleaner and sharper images π₯
2. Aperture β Na your vibe decide this one π
If you like that creamy background blur wey makes bride and groom pop well well, then shoot around F1.2 β F2.0. Perfect for those emotional candid shots when you dey sprint from bride side to groom side like event planner assistant π
3. Shutter Speed β Increase am abeg ππ½ββοΈπ¨
Sunny weather no dey pity anybody. To control exposure and freeze movement while everybody dey dance, spray money and move around, your shutter speed suppose dey high. 1/1000 upwards dey safe depending on how wicked the sun dey that day βοΈ
4. White Balance β Control that wedding heat π₯΅
Sunny weddings naturally dey warm. If care no dey, your couple fit turn orange ππ
Use Kelvin mode and balance am around 5000K for cleaner and more natural skin tones.
Extra Plug π
If you want that hard sunlight effect with sexy sun flares and dramatic shadows, carry reflector.
But if na soft luxury wedding vibes you want, diffuser na your oga π€
At the end of the day, wedding photography no just be camera workβ¦ na cardio + creativity + patience ππΈ
Barnabas Oluchukwu
Creative Director,
Ample Creative Services