Gbese Content Factory

Gbese Content Factory Theirs no Glory Without a Story
It's all about entertainment
Content creator with vibes
Advert

15/02/2026

City Boys vs Village Boys

My people
Make una gather small

Na me
Area Fada
Original village boy
No be by Instagram filter
Na by blister for hand

This village boy grow with silver spoon
But na only me enter bush find my way
Like wooden spoon wey crack for firewood pot
We fetch water before sun wake
We trek sand wey hot pass insult
We sabi hunger like old friend
But hunger/civil war no fit bend our backbone

City boys dey flex for timeline
Champagne for breakfast
Because money na water
Motivation quote for caption
But na borrowed light dem dey shine
Dem wan reap where dem never plant
Dem wan chop fruit from oppressors farm

Village boy plant
Village boy wait
Village boy water am with sweat
Village boy pray
Village boy endure

When harmattan tear our lips
We still speak truth
When rain beat zinc roof
We still sleep with clear conscience

Life no soft for we
And we no beg am to soft
We choose hardness
Because hardness build muscle for spirit

City boy dey fear suffering
Village boy dey use am train

You see
Movement no be noise
Movement na scars
Na discipline
Na standing when crowd dey kneel

Village boy no dey sell future for quick flex
We dey build legacy brick by brick
Even if nail break
Even if palm bleed

We no perfect
But we real

If standing for wetin right mean say we go trek alone
Then make road long
Make sun hot
Make dust rise

Village boy no dey retreat

Na so we be
Na so we go remain

Area Fada sign out
Proud son of the soil
Forever village boy
Forever stubborn for truth

26/08/2025
14/08/2025
11/08/2025
30/03/2025

"My name is Kanayo O. Kanayo, but my real name is Anayo Modestus Onyekwere. I was born in Mbaise, Imo State, and I grew up in a humble home. Life was not easy, but I was determined to succeed.

In 1992, I got my big break in Nollywood with the movie Living in Bo***ge. That movie changed my life. People loved my acting, especially my role as a wealthy man involved in rituals. After that, I became famous for playing ritualist roles in movies like Blood Money and Rituals. Many people even believed I was a ritualist in real life! But I was just a good actor.

Even with my success in Nollywood, I wanted more. So, I went back to school to study Law. In 2020, I became a lawyer. Now, I balance my career as both an actor and a lawyer.

My message to young people is simple: Work hard, stay focused, and never stop learning. Say no to exam malpractice! Education is the key to success."

— Kanayo O. Kanayo

Address

Lagos

Telephone

+2348038061253

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Gbese Content Factory posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share